How Nigerian govnors dey tackle effect of rising cost of living for dia states.

Some state goments don begin take actions to address di serious hunger plus di rising cost of living for dia various regions.

Dem take dis steps as Nigerians dey lament di high cost of food items across di kontri.

For some parts of di kontri, pipo don begin enta streets to protest di continuous rise in food prices for Africa biggest economy.

Recently, thousands of Nigerians enta streets for di northern states of Niger, Kano and Kogi and Oyo for western Nigeria, to demand urgent interventions wey go address di rising cost of living as dem claim say di situation don become unbearable.

Price of food items dey increase for dia fastest rate in nearly 30 years. Official record from di Nigeria National Bureau of Statistics (NBS) report say inflation dey at 29.9%, di highest in almost three decades, and food inflation tanda for 35.4%.