Sandzydivva  shared a  post
30 w

Court directive to DSS, oda tins wey happun as Ipob leader Nnamdi Kanu trial start.

Di Federal High Court for Abuja, di Nigeria capital don adjourn di hearing of di leader of di banned Indigenous People of Biafra (Ipob) Nnamdi Kanu to 19 and 20th March, 2024.

Court go rule on di bail application of Nnamdi Kanu wey di defence counsel file, while di main trial go continue on 20 March, 2024.

Justice Binta Bukar weybpreside over di case tell di Department of State Security, DSS to allow Nnamdi Kanu change clothes.

Di judge tok say dem no go allow Traditional attire and beads but im fit wear any plain clothes.

Kanu dey face charges of treason wey Nigeria goment sama am afta dem rearrest am in June 2021.