Tori of coup plot for Nigeria na lie - wetin be di Guards Brigade wey Defence Headquarters tok about.

Nigeria Defence Headquarters don hala say tori wey dey spread round say high alert don dey sake of coup plot for Nigeria na lie.

Di fake tori bin add say di suspicion na im make dem call emergency meeting wey President Bola Tinubu bin dey inside.

Oda pipo wey dem allege say bin dey di meeting na di chief of staff to di President and di Commander of di Guards Brigade.

For statement wey dem release on Monday, dem reveal say di tori wey comot on Sunday say, "di Guards Brigade don dey put on high alert on top unusual movement wey cause suspicion of coup plot for Nigeria", Brigadier General Tukur Gusau, acting Director Defence Information tok for statement e sign on Monday.

Defence Headquarters add say dem "wish to categorically state say di allegation dey false."